Two Ogbonge Bills Don Land For We National Assembly
Persin wey standa for Abak/Etim Ekpo/Ika for we house of rep, Hon. Aniekan Umana don drop two ogbonge bills for we national assembly and dis two bill don Waka pass first reading for di floor of house.
Dis na bills wey go helep put beta school like National Institute for Artificial intelligence and robotics studies for Abak, and Federal college of agriculture for Etim Ekpo for inside him federal constituency
Oga aniekan Umana yarn sey wen dem put dis school, e go helep give work to plenti pipo and give space mek plenti pipo develop and ontop di agric school dis go helep solve problem as e concine we agric sector for we kontri.
Oga aniekan beg mek him follow lawmakers mek dem join hands support di bill ontop sey E go bring bettamen come we kontri Nigeria
