T’clusive:

THE GAME NO BE CHILD’S

you get luck enta school, you don dey feel big boy, you neva matriculate you don join bad gang.
you don dey blow norsh
you waka go find who be your Niggas

Ontop 12:00 laidis, you enter street dey drive neutral boys
you call dem “Jew Man”, collect their kappa, wristwatch and chains based on who you be.

You tell Imaobong make she com your hood, she no gree.
you wait am for night, drill am still collect wetin you been dey find.

You don tell Akanimo to join you, him no gree, him tell you say him pop-man and Momsy go disown am.
You tell am say STREET GET HIM BACK, him no gree.
You remind am say if him belong say e go outshine him papa, sey lectura for school go dey fear am, on top dat, lecturas no go fit fail am for school. you give am orientation full head, he come gree.
Akanimo now turn ya Kartel Man, he don run commot from house, he don dey blow weed, he don dey take TM 500mg, he don dey Achieve people phones and valueables, e don dey handle Gun, Akanimo don turn HardMan.

You try enter Ukpono,
UK na tight Man
he no send you at all base on him belong somewhere
he no dey go gree “show love”
Based on say “na your choppings be that” you arrange mek dem drive am.

Basil argue with you ones ones, you nak am DOWN. Him nigga vex, Dem don carri you for mind, you na dia point and kill

You enter street, everybody dey find their way
everybody believe you
everybody sabi you as Heavy Capacity. Ur mama and papa dey hunger mek you for go school, graduate

Everytime, Everytime you wan high,
you buy TM 500Mg Pour am for LACASERA/COKE
You don high, you wan go MATCH NIGGAS.

You don go match Ukpono brother, based on who you be
achieve him valueables

Ukpono question you
you put call
Your XYz dem arrive
You tell them say small Ukpono group wan Challenge you
Small Ukpono wey you fit show the way

Them arrange Drill Ukpono
Las las na you gain
You be KING for the game
You Roar like LION Based on who you be
Na you get Hood.

Ukpono up him game
weeks don go, Months don pass
your matter still dey him eye
Him wan show you say ” Nobody be King for the game”

Years don go
you dey feel alright, on top dey go soon grad, but
Unto Normal Hit
Ukpono don take you down Eye to Eye
you see your death. School wey Dem send you, you no finish

The Game no be child’s
The Game no be Bobo.

Remember the SAYING: HE WHO KILLS WITH THE GUN, SHALL DIE BY THE GUN.

SHUN CULTISM TODAY!
AND LIVE A NORMAL LIFE…

Leave a comment

Design a site like this with WordPress.com
Get started